Obi Cubana: NDLEA grill Obinna Iyiebu on top allege relationship wit drug traffickers – BBC News

wp-header-logo-1296.png
Spread the love

Wia dis foto come from, OBI CUBANA/INSTAGRAM
Obinna Iyiegbu
Nigerian businessman Obi Iyiegbu wey pipo sabi as Obi Cubana, don tok about wetin im go through when di National Drug Law Enforcement Agency bin invite am for question.
NDLEA bin kwesion Cubana sake of allegation say e get relationship wit some pipo wey dey traffic drugs.
Obi Cubana for one interview wit tori pesin, Ifedayo Olarinde wey dey popularly known as Daddy Freeze, say to even link am to drugs dey very ugly.
Although no be say dem link am to any drug and dem no accuse am say im dey do drugs but dem say sombody wey dem suspect pay money into im account, but to even reason di invitation be something wey im no dey happy about.
Dis latest invite na sometin wey di Cubana group of companies owner describe as "challenges wey im dey face".
For November 2021, Nigeria corruption police – di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bin arrest Obi Cubana.
But Obi Cubana bin no face any legal palava for di mata at dat time wey we know of.
According to Obi Cubana: "In growth, in life pipo must face certain challenges, I dey face my own now, I tink say di tin wey pain me pass be say I bin dey detention for four days and three nights".
Im say e dey sure say di NDLEA get di ability to carry out thorough investigation into di matter as dem go do their job wella as professional wey dem be.
"I know say if dem clear me dem go allow me go, no witch hunting, nobody bin dey afta me."
Oga Cubana add say im never feel so low for im life. E also add say im bin make covenant wit God say im no go ever get hand for anything drug or sponsor dat kind business sake of say e dey destroy generation and anyone fit be victim,including im children.
Wia dis foto come from, OBI CUBANA/INSTAGRAM
Obinna Iyiegbu aka Obi Cubana na businessman, entertainer, entrepreneur plus philanthropist dey for di custody of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).
Obi Cubana: 'Dem no dey cut soap for anybody for dis world!'
© 2022 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Facebook
Twitter
LinkedIn
WhatsApp