Nnamdi Kanu in court: Ipob leader say im no dey guilty, judge adjourn case to November 10 – BBC News

Leader of di Indigenuous People of Biafra Nnamdi Kanu don tok say im no dey guilty to di new charges wey Nigeria goment accuse am of.
Nigeria goment bin sama Kanu wit charges on alleged acts of terrorism and treasonable felony.
Tori be say di Office of di Attorney General of di federation amend di charges against Kanu wey dem don file as a motion on notice for di court.
Not long afta im plea, di judge tok say make Kanu remain for DSS custody and adjourn di case to November 10, 2021.
Di court judge deny di Ipob leader lawyer application for di Department of State Services to transfer am to correctional centre.
Lawyers of di Ipob leader bin no dey happy wit di charges wey di goment bin level against Kanu as dem bin feel say e no get "base in law and e dey worthless".
One of di lawyer to Kanu, Ifeanyi Ejiofor challenge di competence of di charges.
"Di seven count offence wey di goment sama Nnamdi Kanu dey baseless and worthless for rule of law" na so Ejiofor tok. "We dey challenge di seven counts.
"We dey view say di seven count charges no be any offence sake of pesin no fit sneeze for Lodon make e become offence for Nigeria as most of di count dey founded on non existing law".
Di Lawyer add say dem don file application to challenge di competence of di charge and jurisdiction of fi Court to kontinu to hear di case.
Di amended charges against Kanu include:
Detained leader of di proscribed separatist group, Nnamdi Kanu dey expected to appear for court today to ansa accuse wey Nigeria goment sama for im head.
© 2022 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source